Current Events > 'Mama thank you say you born me' How Snoop Dogg mourn im mama death

Topic List
Page List: 1
PC_Genjin
10/25/21 10:31:23 AM
#1:


https://www.bbc.com/pidgin/world-58993152.amp

https://imgur.com/XpkRJxh

Im announce di death of im mama on Sunday, say "Mama thank you for having me" and "Thank you God say you give me angel for mama".

Dis mata dey come shortly afta di ogbonge rapper bin celebrate im fifty years birthday.

Beverly Broadus Green die for di age of seventy. While Snoop Dogg no reveal wetin kill her, im bin post pictures of am for hospital in July.

Dis na as e reveal back in May say make pipo follow pray for im mama.

Several celebs including singer Lizzo, actor, Dwayne Johnson and actress, Taraji P, Henson don follow to mourn di death of di ogbonge rapper mama.

Actor Dwayne Johnson wey dem dey call the Rock, say "I dey sorry Uso. All our Johnson love and mana, we don send am to you and your family".

Rapper Cardi B hala for social media say, "Sorry uncle Snoop. Love and peace to your family."

Singer Lizzo say, "Love you, big bro".

Beverly Broadus Green na evangelist and don write two books wey im call Real Love and Real Love II.

Tori be say she bin dey serve for her church for 42 years until her husband Howard Green die for 2005 and dat na wen she get di calling for evangelism.

For 2015, she open one youth empowerment platform wey she call YouthBloc. Na platform to teach young pipo how dem go fit start successful business and collect business loans.


---
... Copied to Clipboard!
Xavier_On_High
10/25/21 10:39:06 AM
#2:


... Copied to Clipboard!
Topic List
Page List: 1